Make I no lie for you, police get power to arrest anybody wey cause trouble or wan cause gbege for your area. But wey dey always tell our police sey make dem no dey harass people wey no dey do bad thing at all.
If pesin go do bad thing wey be sey if court judge am, he go go prison reach at least three (3) years or make court fit sey make dem go kill am, police fit use force wey make sense arrest am make e no escape arrest.
If the pesin come dey shoot police or commit offence wey if dem convict am, court fit talk sey make dem go kill am or put am for prison wey fit reach 7 years, and the person wan escape wey police no go fit catch am at all, our law sey police fit kill am o.
Make we remind our police dem here sey this one no mean sey make dem come dey kill anybody wey dem wan arrest oo. If a Policeman go kill innocent people, our law talk sey police man fit go prison for life o or make dem kill am too. The reason be sey somebody we dey run from police because of fear, police come kill am and we come realize later sey na innocenty e be, that one no go good at all.
We come advise our people here sey if police wan arrest you, no follow dem fight o. Try reach your lawyer wey know wetin first. Your lawyer go know how to helep you for situation like this.
Pikin wey neva reach 17 years, if e come do bad tin wey dem suppose kill am, se dem go still arrange firing squad for am as e be pikin so?
At all, at all. Any pikin we no reach 17 years wey come do bad thing wey one a good day, na crime wey dem fit kill pesin, the law talk sey dem no go fit kill am.
Pikins, this one no mean say make you dey cause trouble o. E get place wey dem dey carry small pikin like that wey dey cause trouble go if dem don do bad things o.
One woman wey Oga for Court don talk say dem go kpai unto say she do ogbonge bad tin, wetin go happen if the woman get belle? How dem go do im pikin?
If a woman do bad tin and court come sey na to go kill am, dem no go kill am chap chap o. dem go wait make she born dat pikin finish. Make we no forget sey the pikin no do any bad thing. Na pesin wey cause trouble go face am only.
If pesin sick and body don tire am, e fit beg Doctor make e chuck am injection make e die? Or the Doctor fit reason say e beta make the pesin die come chuck am the injection?
Our law no gree dat one for obodo Nigeria. Na true sey for some obodo oyinbo countries, if person too sick wey bodydon tire am, pain com too much for am wey e fit no make am again, dem fit chuck dem injection sey make dem go sleep waka go heaven jeje. We no fit do am for Nigeria.
Our criminal code talk sey:
I hear say if pesin begin wan kill me, and I kill am first, Ojoro cancel. Na true abi na lie?
My pesin, you must to be careful o make you no jump inside water wey fit carry pesin go finally. Pesin wey follow you talk dey tell you about ‘Self defence’ but e no easy like that bcos na court go talk sey wetin happen na ojoro cancel or you don do ojoro yourself.
If person throw Lacasera bottle for your head and you com kill am, my brother, you don enter wetin pass gobe.
People wey don plead ‘Self Defence’ for court know sey court dey look for some things if matta like that happen. Court dey look if:
Our advice be sey make you dey try stay out of yawa wey fit make pesin die because if fight happen or attack, you no dey get time to dey look wether wetin you wan take defence ya self big pass wetin dem carry come attack you..
Na for which level e go reach wey police go take force arrest pesin or kill am ontop sey he no gree make dem arrest am?
Make I no lie for you, police get power to arrest anybody wey cause trouble or wan cause gbege for your area. But wey dey always tell our police sey make dem no dey harass people wey no dey do bad thing at all.
If pesin go do bad thing wey be sey if court judge am, he go go prison reach at least three (3) years or make court fit sey make dem go kill am, police fit use force wey make sense arrest am make e no escape arrest.
If the pesin come dey shoot police or commit offence wey if dem convict am, court fit talk sey make dem go kill am or put am for prison wey fit reach 7 years, and the person wan escape wey police no go fit catch am at all, our law sey police fit kill am o.
Make we remind our police dem here sey this one no mean sey make dem come dey kill anybody wey dem wan arrest oo. If a Policeman go kill innocent people, our law talk sey police man fit go prison for life o or make dem kill am too. The reason be sey somebody we dey run from police because of fear, police come kill am and we come realize later sey na innocenty e be, that one no go good at all.
We come advise our people here sey if police wan arrest you, no follow dem fight o. Try reach your lawyer wey know wetin first. Your lawyer go know how to helep you for situation like this.
Police or Army fit kill pesin wey dey cause trouble if dem oga sey make them shoot?
If pesin dey cause serious riot wey fit kill people or destroy property for area, dem police or soldier come sey make the pesin stop but you sey na to cause trouble dey go you want. If dem oga sey make officers shoot to disperse trouble makers and one of dem come die, deadbody no fit come back come fight o. But if dem oga sey make dem fire when you dey only protest jeje and you no cause trouble or dey cause danger for people, our law sey the junior officer wey shoot go enter gbege.