Where police arrest or search pesin and no come release everything wey dem collect from am after dem don confirm sey he no get case to answer, the police don dey fight fight for im personal interest against the interest of the state. If pesin be innocent and dem don confirm am, everything wey dem sieze from him dem must to return to am.[1]

[1] Kehinde M. Mowoe, Constitutional law in Nigeria 2008, Malthouse law books p. 408/409

If dem wan search your house, the law be sey dem must to bring search warrant before dem fit search your premises. Na few occasion dem fit no need search warrant. This na becos the law self dey protect our home. If dem wan search pesin house, police must obtain search warrant. If pesin wey dem police wan arrest dey hide for inside one pesin house, dem police fit search the house without warrant to arrest the pesin.[1]

This search warrant wey we dey talk, Magistrate fit issue am if e dey satisfy with information wey dem write on oath wey dey reasonable to believe sey dem dey use building, ship, carriage, place to dey commit crime[2].

Pesin wey dey execute the search warrant fit sieze anything wey dem dey use for crime and carry am go show Magistrate wey issue the warrant or another Magistarate so that dem go fit do take legal action ontop the mata. The search warrant fit direct self sey make dem arrest people wey dem find inside for premises wey dem dey search.[3]

Oga for police fit issue warrant arrest too but na only if items wey dem wan search na stolen property. If for the premise wey dem wan search, dem come find pesin wey just return from jail within 12 months for offence like he dey receive stolen goods, he dey habour thieves, he dey do fraud or commit offence wey fit carry person go prison – dem must to allow officer wey carry the warrant into the premises to search am. If the officer sieze property inside the premises wey he search, he fit arrest the pesin wey occupy the premises and bring am before Magistrate to come explain how the goods take dey for im prmise. Where dem no come allow the officer make he enter the premise, the law permit the person wey dey execute the warrant to break into and enter the premises make e fit carry out the search warrant.[4]

Again, a police fit break out of the premises after he don execute the warrant[5]. The persin wey dey execute the search warrant fit search any pesin wey dey the premises if he believe reasonably belief sey the pesin dey carry waterver he dey searched for[6].

[1]section 7 of CPA and section 34 of CPC.

[2]section 107(1) of CPA

[3]section 107 of CPA and section 74 of CPC.

[4]section 112 and 7(2) of CPA.

[5]section 8 of CPA

[6]– section 112(3) of CPA and section 81(1) of CPC.

On this kind mata, section 78(1) for Criminal Procedure Code talk sey if dem one search premises, dem must do am in the presence of two respected neighbors wey the person wey dem wan search him call by himself. But court fit no include make neighbour witness the search if the situation no require witnesses.

Police officer fit and e fit no use warrant to search things like vehicle, ship, and an aircraft but nature of wetin dem dey search go determine if dem go use warrant or not.

Custom officers dem get power to search any vehicle, ship or aircraft without warrant if dem reasonably belief suspect dey use am carry goods wey dem supposes sieze.[1]

A police officer fit conduct a search ontop a thing wey he reasonably belief sey contain illegal thing even if e no get search warrant because the officer get duty make he no allow crime happen[2].

The police power to dey mount road block and dey do stop and search, and the power to detain and search vehicle wey dem reasonably suspect sey carry unlawful thing dey for Section 25 of the Police Act. This power no sey make dem dey extort money from motorist o.

[1]section 149 of the Customs and Excise Management Act

[2]section 4 of the Police Act

The law sey if somebody go lie and complain against another wey come make the police go search a premise with search warrant, pesin wey complain wrongly go enter gbege.

Such person wey go lie fit enter trouble becos he take bad belle go lie against another pesin. In one case of Balogun v. Amubikahu[1], the Supreme Court talk sey even for the matter, na police go arrest, detain and prosecute somebody, the real pesin wey dey liable and face the the trouble na pesin wey go take bad belle go lie criminally wey come make police react.

[1](1989) 3 NWLR (Pt. 107) 18

Under our law for obodo Nigeria, abortion na crime o.

Pesin wey be doctor, boyfriend, herbalist, parents, friend who wan do miscarriage for a woman wether e get belle or e no get, and come use something for am or poison or use any force for am or use any other means don enter trouble be dat” [1]

A woman wey wan comot belle come do everything wey we talk above now don enter trouble.[2]

Any pesin who come illegally supply or get anything wey he wan use to comot belle for woman who get belle or no get belle, don comit crime.[3]

[1] Section 228 of the Criminal Code

[2] Section 229 of the Criminal Code

[3] Section 230 of the Criminal Code

For obodo Nigeria, parents get rights ontop how dem dey raise dem pinkin. On who go get the right to put pinkin for im custody, na court dey decide that one o. wetin court consider na who go fit propmote the child welfare well.

Parents rights ontop dem pinkin which include the “rights, powers, freedom and responsibility which parents get dey for international law wey Nigeria too don put hands sign”[1]

Under the Convention on the Right of Child, Nigeria and many country dem wey don sign the convention like Nigeria go respect the duties, rights wey parents get ontop dem pikin and where local custom respect rights of dem family members for as law take protect child rights”

The convention come accept the rights of parents on condition sey if the parents rights no go against the rights of the child. The convention say na parent go get dem pinkin for dem custody but e fit no be so if the pinkin interest no dey protected under such parents.

Right of parent wey dey raise im pikin cover make parents determin pikin education, religion education, and other things wey go teach the pikin good moral till the pinkin go don reach age where he/she go don mature to dey take decision for himself.

Dem no fit make child to dey receive instruction ontop religion or education matter wey no be im religion or wey him parents or guardian no approve.

Parents rights cover assistance or services wey pikin fit do for the parents,[2] the right to discipline and rebuke the pikin”[3]

Kind punishment wey such parent go give pikin no suppose bo one wey go fit put the life of the pinkin in danger. Parents fit commit crimeor go prison if dem go discipline pinkin in hard way.[4]

Parents get power to consent to the marriage and collect dowry when there pinkin reach time to marry[5]

 

[1] J. M. Eckeedar “What are Parental Rights?” (1973

[2] Animashawun v. CT Wang 1974 11 CC HCJ 1793 quoted by E.N.U. Uzodike, Implications and Limits of Parental Rights in Nigeria, published in the African Society of  International and Comparative Law, Vol.2 pt 2, p. 282

[3] E.N.U Uzodike, op. cit., p. 287

[4] Section 295 OF THE Criminal Code

[5] Osanwonyi v. Osanwonyi (1973) 3 UILR 527.

Naija people dem get right make anybody pokenose ontop their message, telephone discussion including telegraphic communications. This right cover wetin dem post or dey send for internet, social media. The content wey dem cover inside no other pesin suppose see am except sey the sender put am make others fit see am.

Na crime to they stop, search, rob, hid or destroy postal matter or telegram[1]. Infact all style wey govment dem wan use to regulate social media don make people react sharp sharp against am becos the right of people to dey communicate dem fit dey tampwer.

We suppose tell una sey Section 45 of the Constitution no make this this right supreme which come they make police, DSS dem dey access our phone conversation ontop sey make our national security no come enter gbege.

[1] Section 161 and 162 of Criminal Code

  • Introduction

This right to fair hearing na one principle wey no gree make dem  give pesin bad judgment or do magomago or partial for am.

The right talk sey if pesin dey for court;

  1. Make dem allow am talk his own as the matter be;
  2. Make the pesin wey wan judge the mata no do ojoro for am; and
  • Make dem no waste time untop the matter

If any of the three wey we just talk now no dey for any matae, na magomago be that[1].

Wetin the right dey talk be sey, all to people wey carry matter come court make dem tell you wetin happen[2] and  make the person wan judge dem  no do wuruwuru to the answer.

Wetin mata here be sey as the Jude they judge the matter, anybody wey dey siddon look as the judge dey handle the matter go throway salute for the judge sey e no dey do ojoro at all.[3]

The judge no suppose get interest for anybody wey e dey decide their mata and the judge no suppose get interest inside the matter[4]. Becos if pesin wey go judge ya matter na pesin wey dey accuse you bring am come or e dey related to pesin wey dey accuse or challenge you, na magogmago be dat and the constitution talk sey the judgment nwey go come out of that case no go fit stand at all weda na court e take happen or if dem set up panel for you any where including your office sef..

[1]See Effiom Vs. The State (1995) 1 NWLR (pt. 373) 507.

[2]See S.287 CPA. See Otapo Vs. Sunmonu (1987) 5 SCNJ 57.

[3]Ajibaiye Vs. Ajibaiye (2007) All FWLR (pt. 359) 1321.

[4]See Garba Vs. Uni-Maid (1986) 1 NSCC 245; Yabugbe Vs. COP (1992) 4 NWLR (pt. 234) 152

If na you or any pesin around you dey court or tribunal or panel make you no forget wetin we wan yarn you now. Just dey read am below:

 

The matter dem suppose do openly make everybody see am

The matter suppose be one wey people fit come enter dey watch as dem dey take do am. If na for the one wey dem no sey make people no enter for security reason, judges dem no suppose go do hear mata and pass judgment for dem backyard or chambers.[1]

 

Every pesin na innocent

Pesin wey dem charge go court for any bad thing, na innocent the pesin for that period until court confirm sey na true e do bad and come convict am before anybody go fit call am criminal. If people or police dem dey call pesin criminal, the law sey na bad thing those people do and na mouth diarrhea dey worry dem.[2]

 

Dem must tell pesin the offence wey he don commit

If dem arrest pesin sey e don commit offence, dem must to tell am in language wey the pesin understand wetin dem talk sey he do. This one na constitution join am to Section 35 (3) of our constitution wey dey for arrest and detention mata. If dem no tell am the offence we e commit, na wrong thing dem dey do and the acusse fit use am against dem lattter. But if dem go tell am another offence wey the punishment no reach the real offence wey e commit, the law sey the mistake no be big thing.[3]

 

Dem must to give you time and everything wey you need to go defend himself

Pesin wey dem sey e don do bad thing suppose get time and everything wey e need to go defend himself. The kind time wey we dey talk here no be only the first day wey de matter reach court, the pesin suppose get adjournment when he suppose get am.[4]

Make ya no forget sey court no go dey gree adjournment wey no make sense.[5]

If you wan adjournment becos you wan bring ya witness come court, you go show court sey:

  1. The witness dey important for ya case
  2. No be you cause am as the pesin wey bring come no show before dat time
  • You dey very sure sey fit bring the witness for the date wey you promise.

 

Right to choose lawyer wey you like to defend you or you wan defend yourself

No body suppose deny you your right to choose lawyer wey you want. No body suppose force a lawyer ontop you. And if you wan defend yaslef, na your right. [6]

 

You get right to ask questions from witness wey other people bring come against you

As pesin get right to bring witness to court and ask dem questions, na so e get right to ask question from witness wey others bring to testify against him. This one na constitution talk am and e dey very important.[7] If dem no gree make you ask witness question, any judgement wey dem give ontop the matter go fail.

 

 

Right wey sey make dem interprete wetin happen to pesin

If dem accuse pesin sey e don commit offence, dem suppose tell am sharp sharp for language wey he understand if e no sabi English or language of the court. The kind offence wey he don commit wey make dem charge am for court. If dem no do this, any judgment wey dem give against am go fail .[8]

If dem give am interpreter wey no dey competent, any judgement dem give against am go fail[9].

If dem come give am interpreter, he no suppose pay any money for the service at all.

If the persin no come sabi language when dem dey speak for court, he come dey there dey look like lukuluku and no talk am for court sey e no sabi the language, na the pesin sabi o because dem go see his complain later as minor thing[10].

 

Your right to mashonu (keep quiet)

You get right make you no talk anything at all o. This right na the constitutional give you.[11]

 

Make we talk am here sey if the offence wey dem charge you na big one like muder, armed robbery, e dey compulsory make you get lawyer o.

[1]S. 36 (4) of the 1999 Constitution

[2]Eyu Vs. The State (1988) 2 NWLR (pt. 78) 602. Okoro Vs The State (1988) 12 SCNJ 19. Uso Vs COP (1972) 11 SC 37. See the exceptions  in SS. 141 (3)(b) & 142  of the Evidence Act. See the proviso to S. 36 (5) CFRN.

[3]Sections 36(6)(a), 179 (2) CPA; 218 (2) CPC; Maja Vs. The State (1980) 1 NCR 212, Nwachukwu Vs The State (1986) 4 SC 378.

[4]See Section 36 (6)(b) of the 1999 Constitution, Udo Vs The State (1988) 3 NWLR (pt. 82) 316. See also Gokpa Vs. IGP (1961) 1 All NLR 423

[5]See   Yanor Vs The State (1965) 1 All NLR 193; Shemfe Vs. COP (1962) NNLR 87.

[6]S 36 (6)(C) of the 1999 Constitution

[7]See Section 36 (6)(d) of the 1999 Constitution, Tulu Vs Bauchi N.A (1965) NMLR 343; Idrisu Vs. The State (1967) 1 All NLR 32.

[8] See Section 36 (6)(e) of the 1999 Constitution, Anyanwu Vs The State (2002) 13 NWLR (pt. 783) 107.

[9]Ajayi Vs Zaria N.A.(1964) NNLR 61.

[10]Udosen Vs. The State (2007) All FWLR (pt. 356) 669. See also The State Vs Gwonto (1983) 3 SC.67

[11]See– Sections. 36 (11) of the 1999 Constitution, 160 (a) of Evidence Act; 287 (1)(a) CPA; 236 (1)(a) CPC. See also Sugh Vs The State (1988) 2 NWLR (pt. 77) 475.