For Naija to fit achieve national co-operation to dey solve problems of economic, social, cultural, or humanitarian character, and for us to dey promote respect for human rights and fundamental freedom and make pesin no dey diffrentate from race, sex, language, or religion, n aim make our right to freedom from discrimination must dey guarante.
The universal declaration of human rights[1] support this rights as foundation of freedom, justice and peace for this world”.[2] Aricle one of the Declaration come talk sey:
Na everybody dem born free and equal for dignity and rights. Dem dey reason and get Conscience and dem suppose act towards one another for spirit of brotherhood.
Discrimination na one way to violate pesin rights”[3] and dis don destroy lives and properties.
Section 42 for our 1999 come talk sey:
Naija citizen wey come from a particular community, ethnic group, place of origin, sex, religion or political opinion no go-
- Dey subjected to disabilities or restrictionsuntop which citizens of Nigeria for other communities, ethnic groups, places of origin, sex, religion or political opinionsno dey subject to; or
- Make dem any privilege or advantage wey dem no give other Naija citizen wey come from other communities, ethnic groups, places of origin, sex, religion or get political opinion.
Our constitution come talk again about how important e be make we no dey discriminate against another. Section 15(2) come talk sey “make we encourage national integration but make we no discriminate becos of place of origin, sex, religion, status, ethnic or language association or ties.”
We dey always talk am for Constitutional Rights Awareness and Liberty Initiative sey no body choose where dem born am o. we just grow up come discover sey na one town, villages, states or name we dey bear. We no suppose hate another pesin bcos he no come from our village or bcos no be our parent born am.. make we no dey discriminate either by action even govment dem no suppose discrminate.
[1] 10 December 1948, A.G Re. 217 A(iii), Doc. N.U. A/8/10 (1948)
[2] Kehinde M. Mowoe Constitutional law in Nigeria 2008 Malthouse Law Books . p 499
[3] Gasiokwu M.O.U. ,Human Rights. History Ideology and law, (CA FAB Education books, Jos Nigeria 2003) p. 224
Govment fit collect my property from me?
If Govment dem wan takeover pesin property, dem must do am as law take talk am
Section 44(1) for our constitution talk sey:
No pesin go take over somebody property or interest in property wey dey move or no move for anywhere for Nigeria except in the way wey the law explain.
Wetin that provision dey talk be sey the right and interest of pesin wey get property dey protected if govment want take over the property for the good of the public as law take talk am and dem go pay the owner of the property wetin dem dey call compensation.
Land Use Act don put control and control and management of land for governor of a state, so right of occupancy wey wey dey get on land govnor fit revoke am on behalf of the state for the good of general public.
But pesin fit loose that right to the property if;
The general use of the public wey dem lawyers dey call for public purposes as dem explain am for section 51 of the Land Use Act mean sey that take over of property suppose be:
For example when govment compulsory take over property make dem use am expand cattle market, court sey e dey legal becos no for the benefit of general public.[1]
[1] Sokoto Local Government and Others v. Alhaji Tsoho Amale & Another (2001) 12 WRN 103.
If a Governor go do ojoro collect my property go give him family member, friend or use am, I fit challenge am sey I no gree and collect my property back?
Yes. You fit do this by enforcing your right for court if the Govnor collect you property for himself, family, political Associate and e no come be for the use of the public. For example the court talk am for one case of Ibafon Company Ltd. And Another V. Nigerian Ports Authority PLC and Others[1] sey any land wey dem collect for private business dey illegal.
Before state go collect person property as the law want am, dem must to fulfil the condition wey wey explain so:
No forget sey Govnor fit offer another place to compensate pesin wey dem takeover im property for the benefit of the pupblic. Where the value of new place wey dem give am dey higher pass property wey dem collect from am, the persin fit pay the excess to govment in form of a loan.[4]
[1] (2000) 17 WRN 56 at 68 CA
[2] Section 28(6) of the Land Use Act
[3] Section 44 of the Land Use Act
[4] Section 29(4) of the Land Use Act
Helep me o! My land get oil, plenty mineral resources. Govment wan take am o.
Yes. Any land or propertyor territorial waters and exclusive economic zone of Nigeria wey get any minerals, mineral oils and natural gas na federal govment get am automatically. If pesin first buy am, you go need to revert am back to the federal govment if you discover sey such mineral or gas dey. Govment must to pay compensation to you for the land and improvements wey you don do ontop the land[1]
[1] Kehinde M. Mowoe, Constitutional Law in Nigeria 2008, Malthouse Law book at p. 520
Put me tru abeg: I wan buy property. Which five (5) document the property must get?
Anybody wey claim sey e get property suppose show document as evidence. Five documents wey every property in Nigeria suppose get we go give you. If your property no get any of them, you need go discuss with a real estate consultant or lawyer sharp sharp. The documents na:
[1]Written by Ayobayo Babade and Olakunbi of Tope Babade & Co (Real Estate Consultants) as a contribution to #KnowYourRightsNigeria project
Wetin be my rights sef as Tenant for Naija?
A tenancy na relationship for which a party (the tenant) get possession of a property (the demised premises) from another party (the owner or landlord) for a specific period of time after hedon pay money (rent) or for free.
Tenant get rights. Im right be:
[1] Written by Ayobayo Babade, Tolulope Olusunmade and Olakunbi Yakub of Tope Babade & Co (Real Estate Consultants) as a contribution to #KnowYourRightsNigeria project
Wetin be my rights sef as Landlord for Naija?
Na landlord get property. After tenancy end, the premises dey go back to the landlord. People dey own property for many reasons. Some na to get income as some dey use am for investment purposedat’s why dem dey let am out to and collect rent. The rights wey landlord get include:
[1] Written by Ayobayo Babade, Tolulope Olusunmade and Olakunbi Yakub of Tope Babade & Co (Real Estate Consultants) as a contribution to #KnowYourRightsNigeria project
My right to freedom from discrimination (Introduction)
For Naija to fit achieve national co-operation to dey solve problems of economic, social, cultural, or humanitarian character, and for us to dey promote respect for human rights and fundamental freedom and make pesin no dey diffrentate from race, sex, language, or religion, n aim make our right to freedom from discrimination must dey guarante.
The universal declaration of human rights[1] support this rights as foundation of freedom, justice and peace for this world”.[2] Aricle one of the Declaration come talk sey:
Na everybody dem born free and equal for dignity and rights. Dem dey reason and get Conscience and dem suppose act towards one another for spirit of brotherhood.
Discrimination na one way to violate pesin rights”[3] and dis don destroy lives and properties.
Section 42 for our 1999 come talk sey:
Naija citizen wey come from a particular community, ethnic group, place of origin, sex, religion or political opinion no go-
Our constitution come talk again about how important e be make we no dey discriminate against another. Section 15(2) come talk sey “make we encourage national integration but make we no discriminate becos of place of origin, sex, religion, status, ethnic or language association or ties.”
We dey always talk am for Constitutional Rights Awareness and Liberty Initiative sey no body choose where dem born am o. we just grow up come discover sey na one town, villages, states or name we dey bear. We no suppose hate another pesin bcos he no come from our village or bcos no be our parent born am.. make we no dey discriminate either by action even govment dem no suppose discrminate.
[1] 10 December 1948, A.G Re. 217 A(iii), Doc. N.U. A/8/10 (1948)
[2] Kehinde M. Mowoe Constitutional law in Nigeria 2008 Malthouse Law Books . p 499
[3] Gasiokwu M.O.U. ,Human Rights. History Ideology and law, (CA FAB Education books, Jos Nigeria 2003) p. 224
Dem fit do me bad bele bcos I be man or woman, or becos I waka come from one area or tribe?
Any distinction, exclusion, restriction or preference becos of sex, colour (albinism) race, town, villages, tribe, ethnic region, geo-political zones just sideline pesin make e no enjoy wetin other Nigerian fit benefit our constitution no gree at all.
Wetin be rights of women on top culture, burial, native tradition mata or when time reach to share property?
To dey discriminate against woman na act wey dey unlawful for Nigeria.
Section 15 and 16 for Convention on the Elimination of all forms of Discrimination (CEDAW)[1] condemn discrimination for women for parental rights mata, reproductive rights wey relate to how to space pikin of number of pikin pesin wan born, or make dey dey push women aside on top property, family name wey woman fit use, kain profession for women or untop education mata.
Some practices still dey for some are for Nigeria against women especially for traditional and cultural practices ontop inheritance, burial rights, political empowerment, child marriage, marital and parental rights wey no supoose be.
On discriminatory practices wey relate to make woman inherit property or for burial rights, some women don dey fight for dem right as dem don dey go court. For ne case wey dem dey call Onwo v. Oko[2] a member of the Assemblies of God talk sey em discriminate against am the wey dem treat am make she mourn pesin wey don die for her community wey go against her belief Court of Appeal come give judgement wey favour the woman .
Also for the case of Augustine Nwafor Mojekwu v. Caroline Mgbafor Mojekwu[3], dem explain sey under Olu Ekpe custom for Anambra state, na only male child go inherent dem papa property. If male child wey suppose inherit the property come die where he no get male child, n aim papa brother go inherits dem papa property. If dem papa brother die, na the brother son go inhereit all dem papa property. The Court of Appeal come condem the practice.
Our people, we dey respect culture, religion and custom well well but dey sey make we no do am against our women or brothers.
[1] UN, Treaty series, vol. 660, p. 195
[2] (1996) 6 NWLR (Pt. 456) 584
[3] (1997) 7 NWLR (Pt. 512) 288
Wetin be my righst if people dey do bad bele for me because I get my own religion?
Our constitution forbid any discrimination action for our govment as it give everybody right to practice im religion as e dey perform im duty.
No body suppose discriminate against another ontop religion or becos the pesin na free thinker, Muslim, Christian, or e dey worship traditional religion or e dey worship anything wey he n aim god.