Article 2(1) for Protocol to the ECOWAS treaty for free movement of persons, residence and establishment[1] give people from ECOWAS countriesthe rights to enter, reside and establish in the territory of dem member states.
The entry without visa no come pass ninety (90) days after which pesin go apply for extensionand na immigration official go fit approve am.
Pesin wey wan go ECOWAS Country from Nigeria suppose get valid passport issued by a member state of ECOWAS wey immigration officials fit endorse[2].
Lastly, ontop sey pesin na from ECOWAS country, dem fit refuse am entry if dem see am as pesin wey dem not fit allow to dem country under dem laws.[3]
[1] Official Journal of ECOWAS, Vol. 1, June 1979
[2] Article 1 & 3 of the Protocol
[3] Article 4 of the Protocol
I wan go dem ECOWAS counties. Dem talk sey I no need visa, wetin I suppose know before I travel?
Article 2(1) for Protocol to the ECOWAS treaty for free movement of persons, residence and establishment[1] give people from ECOWAS countriesthe rights to enter, reside and establish in the territory of dem member states.
The entry without visa no come pass ninety (90) days after which pesin go apply for extensionand na immigration official go fit approve am.
Pesin wey wan go ECOWAS Country from Nigeria suppose get valid passport issued by a member state of ECOWAS wey immigration officials fit endorse[2].
Lastly, ontop sey pesin na from ECOWAS country, dem fit refuse am entry if dem see am as pesin wey dem not fit allow to dem country under dem laws.[3]
[1] Official Journal of ECOWAS, Vol. 1, June 1979
[2] Article 1 & 3 of the Protocol
[3] Article 4 of the Protocol
Wetin I fit do wey go make dem govment seize my travel passport?
If dem sieze passport, e different from when dey withdrawl pesin passport. If dem withdrawl am, you fit no get am again. If dem seize am, dem fit release am latter. If dem seize am, dem no wan make you movement go beyond Nigeria be dat. People wey dem fit seize their passport na criminal suspect, convict, or somebody wey dey detension as law take provide.
Who dem go fit carry or pack like Sandine comot from Nigeria go answer gbege question for another country and how dem dey take do am?
One treaty dey wey gree do fo me and make I do for (reciprocity) between countries, one country fit surrender its citizen to another country, if dem request for am untop sey e don commit crime for the country wey dey request for am but the pesin don run go im country where dem born am. This kain process na thru diplomatic channels dem dey take do am.
Before dem go fit extradite the pesin;
Nigeria fit refuse the request to extradite im citizen if the request no dey inline with her terms of the treaty or the matter wey happen dey related to political or military offences, or e no follow as our constitution talk am or e fit go against national interest of the wey dey make request.
Wetin go fit happen we dem immigration no go gree make a visitor enter Nigeria or pursue foreigner comot from Nigeria make e dey go him country by force?
Dem fit send away Non-Nigerians as law take provide for am. Section 18 for Immigration Act sey dem no go allow people come Nigeria or go send commot from Nigeria foreigner we do all we explain here:
If I be Army or police, I fit join workers union dey fight for my interest and we fit go on strike too?
Section II for Trade Union Act make am illegal for Army and police dem, the Nigerian security printing and minting company, prison services, customs preventive services, Central Bank of Nigeria, dem employees wey law permit to dey carry, Federal fire service dem to dey organize themselves or be members of trade union ontop employment purposes. Dem fit join consultative committees for dia establishment.
My right to assemble peacefully and associate (Introduction)
This right too dey very important and all international, regional and national laws recognize am. Na all of us like to dey assemble, associate marry, join organization as we want protect and promote our interests.
Section 40 fo our constitution talk sey:
Na all of us dey get right to assemble freely andcom associate with other people wey we want, again pesin fit form, belong or join any political party, trade union or any association wey fit protect im interests.
Na two classes of rights this section provide. Na right to assemble and associate freely with other people. We need talk here sey any assembly will go cause trouble for public peace and order, dem go declare am sey e no dey for constitution.
If I get wetin dey vex me, I fit protest?
Our law gree sey make we protest anything wey we think sey e no good. But the rule be sey, our protest must dey peaceful or lawful. Any kain assembly wey come lead to riot, danger or killing people no be kind protest wey constitution sey we must to do.
If I get right to choose people wey I wan dey follow waka, i fit use the same right decide which school i wan go?
Yes. Your right to determine people wey you wan associate with also cover your choice of school wey you wan go. Abeg hear this one, go need to meet the admission criteria of the school wey you wan go and also abide by the school rules.
If na my right to choose who I wan be with, I fit run commot from marriage wey e fit take my life if I no quick waka comot?
The your right to associate cover your right not to associate with people wey you no want or of your life go dey for danger if you still dey associate with dem. Na your choice. Many spouses don die bcos dem no run commot from some homes wey constitute or pose serious dangers to dem lives E get one popular case of Salisu v. Lawa[1], court sey na breach of constitution when dem give a decision sey make a wife go return to im matrimonial home by force when the home no dey peaceful.
[1] (1986) 2 NWLR (Pt2) 36 CA;
Na by force to join local association for market, village dem?
Under the law, nobody suppose force another to belong to any local association except the pesin wan join such group voluntarily. No matter the amount of shakara or threat from such local association to join them, the law no support am if you no wan join dem. If dem dey force you or dey threaten you, call your lawyer.